RE: RE: Hive-Naija Weekend Engagement #35 - "Blogging or Vlogging on Hive"
You are viewing a single comment's thread from:

RE: Hive-Naija Weekend Engagement #35 - "Blogging or Vlogging on Hive"

Words
278
Reading
2 min
4y

Wey dooh hoo..

I don waka come ooo with my konkon shoe, comot for road make you no go collect for leg..i de rang hopestylist@hopestylist, @Olawalium, fashtioluwa@fashtioluwa, and other gbeboroons to come join this Blogga Vloggas wey samostically@samostically bring con big table..abeg hol lam well make e no break now.

As I de yarn de go, this ofere question make me think am ooo.. Omo i never Vlog...Vlokkk..Vlo... Ei ei, haba! This my keyboard ehhn!! I never Vloggue before, me na to de carry pen like pikin wey de shine eye to thief e mama money buy kuli kuli for janzcsion..

Me no too like that oyinbo thing wey you go stand de turn head like macaroni wey no get tail for front of phone de talk shmm shmm shmm.. Me no sabi all this shhmm sshmmm suntin for cameroh but I de talk die,.. To de Bloggy don de hang my soul like police weh de call opc sey thief de rob for their area..

But as we de look am so, e be like se that Vlogg go make as per se money burekete for diaa.. But sha me don de use to Bloggis as e de make me feel anonymous.. I fiti give life to my imaginason as I like. .. Vloggy de make be like se person de shook me for eye se I waka hit e leg..but Bloggas de sweet my belle like woman wey just get belle de tell e husband se make e wake up se baby wan smell cloth wey de just iron..😄😄.. Hold this wrapper I de come make I buy sepe for mama odikamuahnifukolosherah wey de next jankson.

@balikis95: Wey dooh hoo.. | Ecency