My people I hail una ooo. Na wetin steemit don do me na him i talk say make i yahn una. Even tho na low pay I still dey get. I no vex and I no go retire. Steemit donchange my life gidigba.
The funny part be say I no stop to they write even tho I no dey post every time. Even before I start to dey earn I don they talk am to my friends and family.
Steemit don make me have this special love for people chaii the love too much. Anywhere I go na xoxo steemit I go dey gist.
I don turn envangelist finish for this matter, na like gospel i cum dey handle am. The thing cum be like say if i no talk am people no go enter heaven. Lmaoooo
Thanks to @ogoowinner wey bring this matter and thanks to
@adejoke16 wey tell me say make I put mouth for this matter I hail you ooo my sister.
Na my pigin Torey be this ooo hope una enjoy am.
Please don't mind my pigin spellings. I just say make I try. Thanks for reading.