MY NAIJA PIDGIN CHALLENGE

Words
164
Reading
1 min
Listen
Play
9y

ogoowinner@ogoowinner don come start her own. People like me wey too like gbaza go join follow body. As it dey hot, make I drop my own cuz say it no go end for my domot. For normal ground, I feel say I sabi write. I go enter facebook, instagram, whatsapp etc dey write upandan like say person send me work but na this ogbenge steemit@steemit na him show me say I no suppose waste my talent like that. Say anything wey I fit write, I go fit use am make money. I don dey this ogbenge village steemit reach 2 months na and like play like play I don dey see wetin people dey talk. Steemit na the ogbenge community for people wey sabi. I wan throw salut go my brother side uniquegem@uniquegem, him strong head paddy setapart@setapart and my sister houseofbella@houseofbella wey don see love for community run enter. As 042 dey like this, na we get this commumity. One love my people

MY NAIJA PIDGIN CHALLENGE | Ecency