This content was deleted by the author. You can see it from Blockchain History logs.

NAIJA PIGGIN CHALLENGE:WHY I LIKE STEEMIT

IMG_20180120_082914_933.JPGSource
My ogbenge pipu wey me and them dey do steemit i dey greet oo,i dey for ground.
I wan use this small chance wey i get tell unah why i like steemit,me na still new born pikin for steemit i never sabi boku things for steemit.

But the thing wey me i dey sure say steemit dey do well well na say them dey dash money well well.If you sabi wetin you dey post you go dey get money,na my friend wey introduce me to steemit but since that day wey me i join steemit i don get money wey i no bin dey plan ever get.Steemit na you be baba biko.
IMG_20180120_084047_729.JPGSource

Steemit no dey like MMM or other Ponzi scheme wey you go pay money later them go carry your money run,instead steemit pipu go dash you money for just your post,you go dey even get beta money if you drop beta comment for something wey person post and em touch that person for heart make em upvote you.

I forget to tell unah,i hear say na one fine madam@ogoowinner wey dey do this ogbenge challenge present give us,madam@ogoowinner na so God go dey bless you say you go see too much blessing run.Em be like say i don enter the challenge late but i go still try post something.See as you dey read my work em dey sweet you,tanchu sha.
IMG_20180120_085421_966.JPGSource