My secondary school story

Una weldone my people,I dy happy for this opportunity Wei I see to share my secondary school experience with Una,na this opportunity I being dy wait for teh teh.
My first day for secondary school being make sense,you know for naija,your first day dy always make sense for school base on say they won make you feel at home.
When dy give me admission for one of the best school for my area,the name na Intensive education academy.Na my dream school be that when I being dy primary school,that night to the day Wei I won start the school,morning no fee come oo oh,I no fit sleep,I just dy happy,and i no say every student dy get that happiness when they one start new school.
So that morning I wake up as early as 4am,I dress con enter the school,That day being make sense,I make many friends that day,base on say I dy friendly and funny,so my schooling for there being they go smoothly until their maths teacher resume school because him being dy sick,omo na dy wahala start oo ooh.base one say the guy harsh,and him sabi flog like mad.before him resume they being don gist me of the man,say him na harsh man,him no dy joke with student,so I being dy prepare for the man base of the stubborn boy Wei I be.
So one day him dy teach for school,I con mistakenly talk omo na der wahala start oo oh.
Him say my kneel down,base on the stubborn boy na,I con dy form stubborn boy just to impress the girls wei being dy class,not nothing say na my greatest mistake be that.
Omo before I no cane con come oo ooh,I come try melo,but as I dy melo na their him own con start.
Omo come see flogging,that night I no fit sleep my body dy pain me,since then the guy come put eye for me.for that one mistake my secondary school being no dy easy.
My name con enter blacklist,I con hate the school,If I reach school gate my mind don spoil.
So after my graduation from junior secondary school,I being no get plans say I go continue the school just because of the maths teacher,so for that vacation period I con decide
Say my go dy do lesson not knowing say na that my maths teacher dy don the lesson.
So with the hatred na,I no con dy concentrate,so with time I con realize say the man na good person,him con dy opposite of Watin I think say him be.I con like the man
So I con decide to come back my do my senior secondary school for there
So na my graduation pic be this Screenshot_20200722164233~2.png

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
12 Comments
Ecency