MY PIDGIN STORI

Wetin I sabi chop done land for my front o. Today I just landed am for hive naija discord server for this pidgin contest. If you wan follow shoke mouth, see the ogbonge link here My Pidgin story. Make I carry my body go share my own matter jor.

APRIL FOOL O

As children nau we know how things dey go when April first come. Na big day to fool many people. But for my own case, I always dey forget everybody done know me say I too dey forget so na my dey always dey use as example to carry out their April fool game. All this dey go on not until one dey wey den do me one bad one. That one enter me go inside my body wey be say till today I still dey remember the tori like say na yesterday the matter happen. The tori na between me and my big sis. Read make you enjoy the gist jor. I know say you too dey padun ofofo like sugar lol.

Omo one fateful day like dat sha, as man pikin just they wake up, my sister just come met me say one woman dey share sweet give small small pidgin. My head first spark like wire, when she come show me her own. Kai, who no like free things na so I run comot from bed run. I no even wear slippers, na so I run reach there ask the woman for my own sweet. Na so den tear me agbele (disappointed) say no she no dey share sweet. Hmm, I carry my two two leg Waka go house. As I reach, they come tell me say na April fool. I vex no be small. That one no be the first time den done they give me different April fool.

I come start to they plan my own give my big sis. Days waka pass, even month then the next day come be the April fool. I done ready everything. Next day, early momo, I go wake my big sis say one person dey share money. True true, the person I use dey always share money some time but dat day. Shi shi, he no dey share. Sharp sharp, she run Waka go. See my own bad o. I make sure say that place far wella. Before she come back, I burst to dey laugh like say I inhale laughing gas. I come tell am say na April fool too. Since that day, na so April fool stop o. Everybody come hold his own lane.

This one na my own quick matter for this ogbonge contest. I go api if this type of pidgin contest fit dey come out once in a while too. Thanks everyone for this contest.

H2
H3
H4
3 columns
2 columns
1 column
Join the conversation now
Ecency