This content was deleted by the author. You can see it from Blockchain History logs.

WETIN I DO WHEN I SMALL WEY MAKE DEM DISOWN ME.

image
Source WhatsApp

Another beautiful Thursday morning on top our ogbonge blog the one and only naijapidgin. Anyother one na beta counterfeit. My country people, how una dey? Our Muslim brothers don jollification finish even though naijapidgin felicitate with una, una no fit even send us small meat make we chop. Anyway, we believe say holiday don finish and serious business don start.

Today for we blog Sha we no go dey too serious. Oyibo talk say all work and no play na im dey make Jack wetin e dey make am. So on top that levels na im make me reason say e go good make we see wetin go make us laugh small. Wetin I dey talk about?

All of us get childhood stories. Those things wey we do when we small wey we take chop better cain or punishment. I sure say una still remember. Before una write una own make me first yarn una my own but make you no laugh o.

When I small I stubborn no be small. I chop cain wella. If I say make I list am this blog no go reach but I go tell una one wey I no go ever forget. So e be say when I finish JS 3 exam wey Dem dey call junior waec I come dey reason wetin I go dey house do for 3 months before SS1 na im devil come visit me say make I still books from my school library. Dorithy international school then no dey let person carry more than one book comot without signing. Na so I tell two of my girlfriends we come enter dey hide the book for stomach carry comot. I carry 9 story books then na so holiday start o body come dey sweet me.

I no know say school don dey find the books. My mind be say when school resume I go return the books but for where? E don well for me. I tell my brother make e no carry any of the book go him own school wey be living word academy because him school and we own dey share siblings. Na so my brother come carry one of the book go him school, e no do am he carry am borrow one of him friend e come be say that him friend na the younger brother to the library prefect for my school. Infact my country people, fear no let me complete how this story take end.

Oya now, I know say no be only me stubborn for small pikin. If you know that thing wey you do for small pikin wey make kasala burst oya yarn us make we use am laugh this Thursday morning comot cold for body.

Na @zizymena carry this one come una domot o. Oya now. I dey wait to break my rib with laughter. God go bless our hustle today o. Una good morning

Footnote

**If you would like to support us,

Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to *promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows*


Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

[Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Steemit Diary + Amebo with @rebeccafl [Fridays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapodgin Team:

The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...

@ogoowinner

@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde